'We sabi who kill 17 sojas for Delta State, we dey follow am up'

Chief of Defence Staff, Maj. Gen. Christopher Musa

Wia dis foto come from, OTHER

Nigeria Chief of Defence Staff, Major General Christopher Musa say di Nigeria Army sabi who dey responsible for di killing of 17 soldiers from 181 Battalion wey bin go peace mission for Okuama community for Delta State.

For one press briefing wey di CDS give, e say dem kill Lieutenant Colonel A.H. Ali and im men becos im bin dey try end illegal oil bunkering wey dey happun for di Niger Delta creeks.

“We sabi who do dis tin, we dey follow am up, and na just a mata of time, we sure say we go get am,” General Musa tok.

E say many of di militants wey dey do oil bunkering dey get plenty weapons and na one of di ones wey dey benefit from am na im kuku use di opportunity of di fight between di two communities kill Lt. Col. Ali.

Nigerian sojas

Wia dis foto come from, @HQNigerianArmy/X

Di killing of di troops make pipo of Okuama begin panic sake of fear say di military fit come revenge by clearing evribodi for di village.

But di Nigerian Army for one statement assure law-abiding citizens of Okuama say dem no go retaliate afta youth gang kill di sojas wey bin go on peace mission on Thursday 14 March.

For dia official X page on Monday 18 March, di Nigerian Army tok say make pipo of dat community continue wit dia normal activities even as efforts dey go on to arrest di criminals.

According to di Nigerian Army wey share di sojas photo on X, di gang kill di personnel and also rip out dia hearts.

Military personnel bin go Okuama community for peace mission wen dem ambush and kill some of dem

Wia dis foto come from, Supplied

Wetin we call dis foto, Military personnel bin go Okuama community for peace mission wen dem ambush and kill some of dem

'Di cowardly offenders wey dey responsible no go go unpunished' - Tinubu react to Delta soja killings

President Bola Tinubu don give di Defence Headquarters and Chief of Defence Staff full authority to bring to justice pipo wey dey responsible for di tragic killing of officers and sojas for Delta state.

Di Nigerian leader for statement say dose wey commit di crime no go-go unpunished.

Di incident happun on Thursday, 14 March wen some community youths ambush sojas wey bin dey respond to one crisis between Okuoma and Okoloba communities for Delta state.

“Di military high command don already dey respond to dis incident. Di cowardly offenders wey dey responsible for dis heinous crimes go dey punished.” President Tinubu tok.

One Commanding Officer, two Majors, one Captain, 12 sojas and one civilian die for di attack.

Skip Twitter post, 1
Allow Twitter content?

Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Twitter post, 1

Di Delta state govnor Sheriff Oborevwori also react to di killing of officers and sojas wey dey attached to 63 Brigade for Okuoma community, Ughelli South Local Government Area of di state.

Govnor Oborevwori condemn di killings and promise to take all measures necessary to fish out all those wey dey behind di attack and ensure say dem face full wrath of di law.

E also tok sorry to di military and di families of officers and sojas wey die for di attack.

Skip Twitter post, 2
Allow Twitter content?

Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Twitter post, 2

Wetin we know so far on how di killings happen

A group of twenty-two military men on a rescue mission to Okuoma community in Ughelli South local government area, Delta State, bin dey killed wen dem tragically ambush dem.

Reports say di sojas bin dey attempt to free one kidnapped youth wey dem take into captive for one land dispute between Okuoma and Okoloba communities.

Di sojas wey dey led by Maj. Jaffa, according to reports bin dey attacked on dia way back to the waterfront afta a failed negotiation to release di kidnapped victim. Lives bin dey lost for di ambush, including high-ranking officers such as one Lieutenant Colonel, two Majors, and one Captain, along with eighteen sojas

Chief of Defence Staff Christopher order investigation into di death of di troops

On Saturday, di Nigerian military bin confam di tragic killing of four of dia senior officers plus 12 sojas for Delta state.

For one statement wey di Nigeria Defence release on X (former Twitter), dem say di troops bin meet dia untimely death as dem respond to one distress call afta di communal crisis between Okuoma and Okoloba communities for di state.

According to di statement wey di Acting Director, Defence Information, Tukur Gusau issue, e say some community youths surround and kill di military personnel wey bin dey on a peace mission go Okuoma community for Bomadi Local Government Area of Delta state.

Skip Twitter post, 3
Allow Twitter content?

Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Twitter post, 3

Di sojas wey die for di attack include di team commanding officer, two majors, one captain and 12 sojas.

Meanwhile, di Chief of Defence Staff Christopher Musa don order immediate investigation into di tragic incident.

E also order for di arrest of everyone wey get hand for di terrible crime wey happun on Thursday, 14 March.

Di military say dem don arrest some pipo and steps dey in place to expose di motive behind di attack.

Reactions trail di killing of military personnel for Delta state

Di senator wey dey represent Delta North for di National Assembly, Ned Nwoko don give assurance say those wey dey responsible for di death of di sixteen sojas go dey identified and brought to justice.

For statement e release on X, oga Nwoko advise all parties wey dey involved to maintain calm and make dem no retaliate as dat fit worsen di problem.

E add say male authorities cary out thorough investigation into di incident and

“Make both state and federal goments quickly setup an all-inclusive panel to investigate di underlying causes of di crisis between di two communities, di reason for military intervention, plus di resulting casualties on both sides.”

Former Nigeria vice president Atiku Abubakar for im reaction to di killing, urge military authorities to exercise restraints for dia response.